Act 1 Sc1- Loc: At an uncompleted building site - Time- Day- props- normal clothe
It opens on Ken as he is seen carrying a head pan filled with sand as he carries it to the site. After some minutes he decided to take a rest alongside other workers.Ken: (Eating Bread and coke as he discusses with his other two friends)
This their bread no de fresh (feeling dissatisfied with the bread )
Emii: Thank God say I no buy bread today, I for don follow you de complain
Ken: You get confam luck. Na so my 350 go just go
Kelly: see as only am de chop (cuts small bread from Ken's) you no fit call us
Ken: bread de, na una wey no wan chop, de playyy
Emii: this one you talk say the bread no de fresh, I'm not eating
Ken: keep on waiting for fresh bread .... you're not yet hungry ( As they were discussing, a woman selling agbo past, as they all looked at her direction)
Kelly: fuck, this is nyash..... This one go sabi bend guyy
Emii: Na nyash go kill you. No go find babe, de dia de chase girls.... Girl neva do you something
Ken: coming from someone who has received numerous Heartbreaks (He said as him and Kelly burst into laughter)
Emii:(to Ken) I just de wait de day u and your babe Amaka go break up
Kelly: you just de envy them.... Like guyyy
Emii: she go just poison pepper soup give you... U no say na food dem de use hold u wellas.... Shey una de hia I talk this thing..... Till then shaa
Kelly: E no go happen... Nothing like that
Ken: no mind this fool.... Na jealousy de do am (cuts as they continued discussing)