My baby, my Valentine,
Yellow pawpaw, fine geh, angel...babe, notin do you. Na you dey make my temperature dey rise. After that day wey we jam for inside elevator, I just dey wonder how I bin dey live my life before, cause if you leave me, I go die, I swear -you are like the oxygen I need to survive.
You know say as I dey for inside that elevator that day, na sac dem just sac me. Wetin I dey try talk be say, before we begin know oursef, my life done already die leave me. That time sef, I don nearly sabi all Nigerian languages but shey you see that English wey dem dey call 'lingua franca'...make I no go dey embarrass myself too much in case the people for post office kon decide read this thing.
Babe, asides the 'life restructuring' wey you do for me, you con still be christian -confirm christian (e reach to shout am sef). Assuming you no step down small come my level, con raise me up, babe, I don already enter bike wey dey stop for hell fire gate. I no dey lie you. For inside my head, I don even plan how I go silence my landlord, marry im only child con still send the girl go where her papa for don dey. Abeg, make I watch my mouth small.
My angel, I love you, no be lie. Any time I see you, or your face just cross mind, my body go dey totori me. Your eyes, as e dark so, be like star. Your light skin con still dey shine like say you rub groundnut oil. No be say I dey whine, I don see girls finish –them no reach.
I no be poet. I no even too pass letter writing back in those days. But see wetin you dey make me do. Love letter. E con be like say you use spell tie me. Abeg, even if na small, smile as you dey read this letter. If you no smile I go feel am for here, I swear. That your smile dey burst brain.
I hope say you no dey reason say na just Valentine dey cause all this long talk, because na me just say make I checkmate my writing skill. After all, next year, na you go still be my Val –no reason am, except if you dey plan come my burial after Val's dayWith love wey full trailer,
Forever your Val.
