WAHALA NO DEY FINISH

4 1 0
                                    


My ele kon talk say she don get belle and she kon wan say another thing, I no even allow am finish before I give am one dirty slap, I vex well well cause I know wetin I be for my mind, I beat this girl sote she peme, I no even quick know say she don die, na the blood wey I see for ground shock me wey I kon stop. 🤒🤕😷

I cry like pikin wey dem just born, I just sitdown for ground dey cry, when my eye kon clear 😭

I kon call police, na for floor dem meet me self. I follow dem go station go write statement, I tell them as everything be gangan, I no even gree collect phone call my papa, cause my heart don break finish as I too love my pepper body Shade. 👮‍♀️

As Shade parents be rich people dem quickly carry the case go court, when my papa hear wetin happen, he show for prison, he first shout for my head say why I no call am make he kon clear the mess? I just look am, I no fit talk anything, papa talk many things, as he wan dey go I kon stand up he kon hold my shoulder talk say...

"Chinedu John Ebubu na now you become man! Person wey never kill with him bare hands never know wetin manhood be, when dem talk say make I bring your mama that time, I first fear but na after the sacrifice everything kon make sense for my eye"

I shock sit down back, water don dey commot for my eyes like rain water, he kon continue

"if I know say you strong like this self, I for wait, I for no send boys make dem touch your woman"

Naso I stand up hold papa shirt dey Shout

"you peme mama" 🤕

if no be all those constable wey kon collect papa for my hand I for really enter papa. Papa just smile do him cloth well, talk say he go get me out.

After one month don pass, dem kon release me, as I dey commot na him I see Gbenga for the first time, he touch me kon shout "johnem the Drake" the guy look like me no be small. 😂

As I leave kirikiri I first go my papa house, tell am say make he forget say he get wan son somewhere, I for wound am self if no be say he get bodyguard wey fit finish me.

Naso I leave Lagos relocate go Abuja.
I mourn Shade and my mama wella for there, I just dey live my life, na after a year I begin dream about the brotherhood, I go see my self dey argue with the brotherhood guru say I no do again, after some time, I no dream again things kon start to dey happen to me, from sickeness all my business suffer.

I try manage but things no just gree work so I kon go back home after some months don pass, as I join the brotherhood again everything kon set for me again, big boy flex kon start again! them sha gimme one oga daughter make I marry, her name na Monica.

I don resign my fate say I no fit born again and I no love the girl as she fine reach, I sha dey do wetin I like, na so monica come one day say she don get belle, as I don know who I be and wetin her papa be I no just talk anything, naso she born the first and second child,
we just dey live like we be roomates and I dey take care of the children like say na me born them, dey flex as I like for street, na this way we dey live for years, until one day...

YAWA STILL DEY Where stories live. Discover now