✳ACT 5 ✳ scene 4✳

34 10 0
                                    







〰♣♣〰♣♣〰









ACT 5

Scene 4

A street in Lagos mainland

sunday, March 5th 2000

(Seme border)









UBONG

Driver, watin na? you never ready go?


(Passengers complaining)


[Interpretation: what is it? Are you not ready to leave?]







PASSENGER 1

Abeg, abeg, abeg me I don commot o. which kind life, eh? Driver go delay e own, custom go follow delay their own for road. Abi una no know say where person dey go e far? (facing Ubong), o boy, I don move ooh.

[Interpretation: please, please, please I am leaving. Diver will delay and custom too on our way going. Aren’t you aware that where we are going is far? Mr., i'm leaving ]






UBONG

Ahh abeg no go na. driver shabi you see instead  of passengers to dey enter your motor, them dey commot.

[Interpretation: please don’t go. Driver, you see it, instead of your passengers to increase they are decreasing]







DRIVER

Abeg make una no vex. Na this woman oo. I dey tell her say all this her rice wey she buy, custom go seize am. Say make she call this okada people, them know how them go follow. Them go carry am go wait for am for okoko. Then she meet them for there.

She don gree finish oo, see me, I  charge her and her two aunties them wey she carry, 1, 1k each as per  say dem no be Nigerians. Na Beninese them be. And if immigration catch them for road them go seize them. Me I know how I go take cross them.

She no they hear, she dey here they speak funbe for me. Sha na watin she go go speak for immigration when we reach there? Me I be igbo boy oo I no dey hear your language. Pay me my money or you carry your load.

[Interpretation: please don’t be angry. This woman is the reason. I told the her the rice she bought will be seized by custom, she should call one of these bike man they are expert at their job. They will carry it to okoko and wait for her there. She agreed. I charged her one thousand naira each for her and the two aunties with her to cross them pass immigration because they are Beninese and not Nigerians if not they will be seized. Now she is speaking her dialect, funbe for me. Is that what she will speak to immigration when we get there? I am from the eastern part of Nigeria, igbo. I do not understand your language. You either pay me my money or you take your bags and leave.]






UBONG

Ah na wa o for story. Matter no dey finish for Nigeria. See, make una settle una matter. I dey H, I dey under that canopy. When you ready call me.

̷T̷O̷R̷N̷ (𝓝𝓲𝓰𝓮𝓻𝓲𝓪𝓷 𝓽𝓱𝓮𝓶𝓮𝓭 𝓷𝓸𝓿𝓮𝓵) ✔Where stories live. Discover now