So everyone dey wonder "What is pidgin and how is it used in a sentence", well I was never a teacher but you can learn whike laughing😁😁😁. And if laff kill u, I no dey for that wahala o😂😂😂
He who fights & runs away , Na fear catch am.
2. Pikin wey no sabi em mama boyfriend, Dey call am brother.
3. A rolling stone no just dey roll, Na person push am.
4. He who lives in a glass house, Na im pepe rest.
5. A stitch intime, dey prevent further tear tear.
6. Birds of d same feather, na d same mama born dem.
7. One good turn, na correct power steering be that.
8. A bird in hand, wetin e wan be again if no be barbeque.
9. Half bread, is better than buns or puff puff.
10. D journey of a thousand miles, Ol' boy e beta make u carry your car go enter aeroplane.
11. The patient dog, Na hunger go kill am.
12. All work & no play, Na Banker be dat.
13. He who laughs last, na mumu, y im no catch d joke d 1st time & laugh when others dey laff!!
YOU ARE READING
Funny Random Things That Only Nigerians Will Understand(ProjectNigeriaUC2017)
RandomThis is just a whole book filled with events, jokes and incidents that every Nigerian person and African person will understand. Note: I do not own any of the Jokes or pictures. I have simply compiled them. Thanks
